< Back to 68k.news TW front page

Israel-Gaza ceasefire: Netanyahu reject Hamas demands, close Kerem Shalom crossing as missiles fire from Gaza - BBC News Pidgin

Original source (on modern site) | Article images: [1] [2]

5 May 2024

Israel don close di Kerem Shalom crossing wit di Gaza Strip afta 10 rockets fire go up, Israeli Defense Forces (IDF) tok.

At least 10 pipo don wunjure for di attack by Hamas, Israeli tori pipo report.

Di crossing na one of di few routes to get humanitarian aid to Gaza.

Di attack come as mediators for Egypt hold tok-tok to broker one ceasefire - and to release Israeli hostages. Israel don tok say dem no go accept Hamas demands to end di Gaza war.

Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say di proposed deal go keep Hamas for control of Gaza, wey go pose threat to Israel.

"Di state of Israel no fit accept dis [Hamas demands], we no dey prepared to accept a situation where di Hamas brigades come out of dia bunkers, take control of Gaza again, rebuild dia military infrastructure, and return to threaten di citizens of Israel for di settlements wey surround di southern mountains, for all parts of di kontri.

"Dis go be terrible defeat for di state of Israel," e add.

Hamas bin send delegation to Cairo on Saturday.

Di main sticking point be like weda di truce go be permanent - as Hamas insist - or not.

Dem dey tink say di tin wey dem dey discuss for di Cairo tok involve one 40-day pause for fight while dey release hostages, and di release of some Palestinian prisoners wey dey Israeli jails.

One adviser to di Hamas leader Ismail Haniyeh tok say di group bin dey look di latest proposal wit "full seriousness". But e bin repeat demand say any deal go need clearly include Israeli withdrawal from Gaza and complete end to di war.

On Sunday, Oga Netanyahu tok say: "Di state of Israel no fit accept dis [Hamas demands], we no prepare to accept situation wey Hamas brigades go come out of dia bunkers, take control of Gaza again, rebuild dia military infrastructure, and return to dey threaten di citizens of Israel for di settlements wey surround di southern mountains, for all parts of di kontri."

"Dis go be one terrible defeat for di state of Israel," e bin add.

Wia dis foto come from, Getty Images

Tens of thousands of Israeli protesters rally late into di night as dem call dia goemnt to sign deal wey go bring hostages home, as more tok-tok for cease fire still dey ground.

Protesters for Tel Aviv bin dey chant "war no dey holy, life holy", as some odas dey accuse Prime Minister Benjamin Netanyahu say im plan na to prolong di conflict for Gaza.

Dis protest dey happun as Hamas delegation bin meet mediators for Egypt on Saturday 4 May.

Di group say e no get any new development, but ads say "new round go begin" on Sunday 5 May.

Negotiators don resume ceasefire tok for Cairo wey don dey for long time now - wey Egypt and Qatar dey try mediate - on pausing Israel attack for Gaza in return for freeing hostages.

Di main issue wey tie wrapper na weda di deal go be temporary or permanent.

As e be now, wetin dem dey discuss involve 40-day pause in fighting while dem release hostages, and di release of some of di Palestine prisoners wey dey Israeli prisons.

One adviser to Hamas leader, Ismail Haniyeh, say di group dey torchlight di latest proposal wit "full seriousness".

But im repeat di demand say any deal must to clearly include make Israel withdraw from Gaza and complete end of di war.

For one interview wit BBC, Israeli minister Amichai Chikli say di war go continue "until Hamas dey eliminated". "We no get di option to agree to deal wey include ending di war or giving up full-scale operation for Rafah," im add.

Separately, one anonymous Israeli goment official tell local tori pipo on Saturday say Israel no go "under any circumstances agree to end di war as part of agreement to free our abductees".

Den im add: "IDF go enta Rafah and destroy di remaining Hamas battalions dia - weda we get temporary pause to free our captives or not."

Netanyahu dey face pressure from within im far-right coalition to go ahead wit di Gaza southern city attack wey im bin promise since, wia about 1.4 million pipo dey take shelter afta dem run comot from north and central part of di strip.

US - Israel biggest diplomatic and military supporter - dey reluctant to back di new offensive wey go cause di death of plenty civilian casualties, and don insist say dem wan see di plan to protect displaced Palestinians first.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Protesters hold signs and flags during one protest wey call for hostages deal wit Hamas

Saturday demonstrations for Israel na di latest display of increasing domestic pressure wey Netanyahu dey face to return di hostages.

Of di 252 wey Hamas kidnap on 7 October, 128 neva return, among dem, di belief be say, at least 34 don die.

Natalie Eldor, one protester for Tel Aviv, tell Reuters news agency say she dey dia to "support deal now, yesterday".

"We need to bring all di hostages back, di live ones, di dead ones. We gatz bring dem back. We gatz switch dis goment," she add.

Some wey gada for di Kirya military base for Tel Aviv accuse di prime minister of damaging di proposed ceasefire agreement, while odas dey call for end to di war.

Addressing di possibility of deal on Saturday, minister Benny Gantz, one member of Israel war cabinet, say: "Dem neva receive official response to di outline yet. Wen dem accept - di war management cabinet go meet and discuss am.

"Until den, I suggest to di 'political sources' and all decision-makers to wait for official updates, to act calmly and not to dey emotional for political reasons."

Ceasefire tok don dey go on for months now witout any breakthrough, and di fight no eva pause plus dem neva release hostages since di end of November.

E get different times wey e bin be like say dem go reach new agreement - only for am to scata bifor dem go fit sign am.

A source wey dey familiar wit dis latest round of discussions tell BBC say di negotiations still dey complex, and any breakthrough fit still take several days.

Meanwhile, di head of di United Nations World Food Programme don warn say northern Gaza dey now experience "full-blown famine".

Cindy McCain warn say di catastrophic situation for di territory dey spread go south, for one interview wey im do wit one US media.

"Wetin wey dey ask for and wetin we continue to ask for na ceasefire and ability to get uninterrupted access to enta safe," McCain tok.

Di war begin afta Hamas gunmen cross Gaza border enta Israel on 7 October, kill about 1,200 pipo plus take more dan 250 hostages.

Many Western kontris proscribe di group as terrorist organisation.

During Israeli military revenge campaign for Gaza, more dan 34,600 Palestinians don die and ova 77,900 wunjure, according to figures from di territory Hamas-run health ministry.

< Back to 68k.news TW front page